Sapele Mega Rally: Mak We Vote Bad Government Commot For We Delta – Sadjere

0 124
CBN

Dem House of Representatives candidate of Social Democratic Party (SDP), Amb. Prince Igho Sadjere don talk am say na only for Social DemocraticParty (SDP) wey go fit get beta candidate wey go fit help comot we state for all the nyamanyama government wahala wey dis ruling party, People’s Democratic Party (PDP) put we Delta inside o!

 

Sadjere don beg all Delta youths, woman, men even elders especially dem Sapele, Okpe and Uvwie pipo mak dem no go fall mugu dis time go dey collect shikili moni tak sell dem future o!

 

CBN

“SDP Progress, no woman no politics, no woman no Progress.

 

“I am so happy to be with una today, E no easy, this time we are winning dis election.

 

“Una get money for bank now but una no go fit collect am wetin una go do now na to vote out bad leaders.

 

“For 24 years dem don suffer us well well, pikin wey dem born for 24 years before now him do graduate o!

 

“Say even for USA, pikin wen dem born for the past 24 years don get grand pikin but for Nigeria PDP and APC dem don get grand pikin for corruption, we must say no to corruption dis time o!

 

“Mak we say no to dem dis time, dat na why SDP bi dem most credible party for Nigeria, na him mak we SDP wan com again o.

 

“Na SDP bi d only party wey don win free and fair election for dis country, d only party wey give free education, mak d soul of my papa wey bi Olorogun Felix Ibru rest in perfect peace, Amen.

 

“I still dey remember wen we dey school, for every 1st October everybody dey get free rice, free education, light na free of charge no bi lie say Felix Ibru don use SDP tak do beta for we state bifor dem jigbiti n wayo party com enter dabaru every thing, I dey lie?

 

“But dis time, we wey bi SDP don com bak as brand new SDP wey get more better and bigger level for development.

“Mak we say NO to dem corrupt money, dem don too deceive us o, dem go dey blame pipo for Abuja wey na dem bad pass o!

 

“Mak we kick dem bad pipo party with dem candidates comot with we vote on 25th February and March 11, 2023.

 

“Mak I remind una, Dem PDP, APC go still com bring dem bad money com give una N1,000 mak dem tak collect una destiny, mak una no gree but say no to bad government o!

 

“Haba see today, if you get N10,000 for bank, how much dem go give u, na N5,000, dem PDP abd APC don kill we state and nation kpata kpata.

 

“Mak we kick dem wayo party comot with we vote beta person wey dey for beta party.

 

“Mak we support me, Amb. Prince Igho Sadjere for Federal House of Representatives, Okpe, Sapele & Uvwie!

 

Support Gbagi for Governor!

 

Support Prince Adewole Adebayo for President!

 

Mak we go vote for SDP for Progress!

 

SDP na for Progress!

 

Sapele Wadoo! Okpe Wadoo! Uwvie Wadoo!

 

Deltans Wadoooo!

 

Mak we Waka o!

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x