Guber 2023: Who Dey Cry Dey See Road, We Never Suffer Reach?

0 134
CBN

Fellow Deltans,

 

…na only Gbagi, SDP go fit uncage state, we we bi Deltans sabi the truth, APC, PDP no bi option if Deltans must survive!

 

CBN

…mak we no allow dem ten n ten pence parti kill we state, dabaru we lives n we children future o!

 

Mak we no forget say politics na game, na people dem dey tak play am, after dem go throw way dem for d suffer wey com out for the politics, mak we use we sense o tak vote person we go fit do beta work mak we state beta.

 

Dem say person no dey see road, follow Bush, I wan ask una one question mak una conscience wake up o!

 

Wetin bi say we don sitdon for dis PDP parti since 1999 wey no give joy for we life, na so so bad road, herdsmen, poverty, hunger, no beta education, market, no pay we pension, no security?

 

Na curse abeg! Wetin we go gain, if we go use we hand dey kill we selves say we wan chop shikili moni today wey dey spoil nyash tomorrow tak finish we life, we children future come still dey encourage we pikin mak dem dey street dey do yahoo yahoo wey police, efcc go dey carry dem every time?

 

Wetin bi say we go still dey suffer dem APC style of government wey bring Naira crunch from CBN and FG impose on all of us wey mak we dey suffer like dis today wey we no even fit collect we own moni wey we suffer mak from bank, e don too much for we bodies, dem wan use naira crunch tak finish we lives mak we vote dem but if we try am, na die we dey o!

 

Mak we change we style act lik beta parents wey we suppose bi tak vote for beta candidate wey go fit rebuild we Delta mak him beta for we children future!

 

Mak we vote beta parti wey get beta candidate wey get beta sense, wey go fit work mak we state beta for all of us!

 

…who no sabi mak him sabi now, God no go com from heaven tak help, na person lik us Him go use talk am o!

 

Mak we vote SDP wey get White Horse, IYESI, Anyinya Ocha, mak Delta state beta!

 

Deltan Wadoo!

 

Mak we Waka o!

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x