Delta Guber 2023: Who Go Fit WORK, Na GBAGI, Na SDP…

0 310
CBN

By Bion Bion

 

We no fit dey do same tin over and over again, make we first check wetin dis politicians and dem party don do for we sef before.

 

CBN

Make we use am take check all of them and their party to know wetin dem fit do for we now wey every where for we state and nation don dabaru!

 

Abeg my brodas and sisters,

Make we use we sense o take vote for we own person wey love we state wey sabi, wey go fit help we state grow so that we sef and we youths and children go get work take get moni take live better life.

 

Even sef make we vote for Gbagi wey no go carry we moni run go abroad dey buy houses, we know say we state suppose get beta schools, hospitals, industries, light make we youth get good employment.

 

Wey go pay pension make we elders wey don work enjoy dem life as dem dey old so that we elders wey don reach 65 years no go dey lie for dem age go dey collect job wey we youth suppose get.

 

Abeg make we as deltans shine we eyes well well, time don come for we to take collect we destiny and we state for we hands o!

 

Support Gbagi, Support SDP for Progress!

 

Deltans Wadoo!

 

We Moove!

Follow us on Facebook @ https://www.facebook.com/868734396503031/posts/pfbid0Jo7pbEDY6Vs2ZFCoTFMdLPVe86Yr4eubFKHftEtyvGNHnVD3ar59vncvSD2Bd2pol/

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x