Delta 2023: Election Never Finish O…Mak We Ready To Vote SDP, Gbagi For Governor!

0 124
CBN

Fellow Deltans,

 

CBN

…mak we rebuild Delta together, mak we youths comot for street o!

 

11th March, 2023 na anoda day wey we go tak decide who go bi we Governor for Delta state.

 

Olorogun Barr. Kenneth Gbagi OON don ready, come mak we go vote for the only industralist wey get dem intelligence and capacity wey state need to progress, wey go fit work mak Delta beta again, mak hunger, poverty, unemployment no finish we youths, children, women and elders.

 

PDP don try dem best, dem no go fit give wetin dem no get, no hope!

 

APC don try too, dem no get talent for rebuilding na continuity dem sabi do!

 

SDP don carry beta goodie bags come, dem sabi wetin bi d problems, wetin to do mak Delta state beta again!

 

Mak we go collect we PVCs tak vote for Olorogun Barr. Kenneth Gbagi OON for Governor!

 

Mak we vote SDP wey get White Horse, IYESI, Anyinya Ocha mak we Delta state Beta!

 

Deltans Wadoo!

 

Mak we Waka Together o!

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x