Delta 2023: Make Una Ready With Gbagi, Carry Horse Take Finish Broom And Umbrella On August 6th…

0 220
CBN

By Bion Bion

Gbagi, SDP dey invite una tomorrow Saturday August 6, 2022, time na 12 noon, venue na Oleh Civic Center Off IDC Road, before Isoko LGA, Isoko South, Delta state

CBN

…no let person use mouth tell you o, come follow welcome  una brodas, sistas, uncles, mothers, fathers, elders for Oleh

All dis parties don finish we state, we country, make we use we sense tak support the Barr. Kenneth Gbagi wey carry  horse spirit  dey come, wey go fit deliver we state from all these nyamanyama, jigbiti and wayo spirit wey dem dey use take finish we state moni.

Make we follow vote for parti wey get horse  make we state BETA, make suffer, hunger, no work no kill we youth, mama and elders o!

Make we deltans no look face o but follow vote we own Gbagi wey dey for beta parti wey get truth and beta life inside.

Time no dey again, make we go get we PVC take commot all dis wayo parti wey no never fit do beta for we state even we country don dey die sef because of their wayo spirit.

Fellow youths, mothers, fathers, elders, business pipo, okada pipo, keke pipo, bus drivers, truck pushers, Hausas, Ibos, Yorubas, Niger Deltans, every tribe wey dey for Delta state make we run carry we PVC vote for Beta Life.

If we mumu go vote for the wayo parti wey dey kill we state since na we go still suffer am, the only solution na for we not to dey look face but vote for Gbagi wey no go thief we moni but go fit deliver and repair we state for beta Life to come.

Vote for Beta person (Olorogun Kenneth Gbagi)!

Vote for Beta Party (SDP)

Gbagi na the TRUTH Deltans must EMBRACE!

We Moove!

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x